Yankee palava

Words
222
Reading
1 min
Listen
Play
9y

DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg

My country people una good afternoon o. Abeg make we first beg una make una forgive us say our Tori no quick land una doorstep today. How una dey? We believe say body dey inside cloth?

The matter wey we carry come una dormot na Yankee levels. Recently my girlfriend go american embassy come back come dey yarn me as people many full for there. E be like say everybody want run comot for we country. If we run leave am na who we want leave am for?

All these countries wey we dey go na so e easy for there? Our people don die troway finish where Dem dey find easy way to run go abroad.

Our question be this:-
Why you feel say people dey run leave naija?

If you get the opportunity you go run abi you go stay for your country?

You go prefer to go there wash plates than make you be manager for one bank for naija?
Abeg make unah chook mouth put sharp sharp make I hear unah Tori

If you like wetin we the do you fit join is for we what'sapp group with this link here

we the always gather in the evening the yarn Tori

nah zizymama@zizymama bring this Tori for naijapidgin@naijapidgin.

IMG_20180215_155325_695.jpg
Nah mittymartz@mittymartz give us this fine avarta.

Yankee palava | Ecency