Wetin dey make you happy?

Words
122
Reading
1 min
Listen
Play
7y

2N61tyyncFaFVtpM8rCsJzDgecVMtkz4jpzBsszXjhqan9uH9a9dQU2hd8UNa9r4FWPtsmX18MXnx5Xv9Ube1Zb33oM59X1JcCYZFu7x93xvwkrQguoGpha2Tp8Z62ZWe8A6MoJZnwtS.jpeg

Una doh o! Our topic today na about jolification.
Wetin be say if you do am, ein go dey totori your body? My pipo, make you no stop to do that o, because life na one man on his own.

Make you no use because say, some pipo dey laugh you, or dey tell you say you don grow pass am, take stop wetin dey make you jolly.

Life sweet well well o, but you go learn to live your life the way wey you want am without other people's interference, before you go begin enjoy your life as you take want am.

Oya o. Wetin be that thing wey dey make you happy? Ngwa quick go do am and enjoy yourself.

Wetin dey make you happy? | Ecency