SECOND CHANCE

Words
365
Reading
2 min
Listen
Play
9y

IMG_20180215_155325_695.jpg

My country people I greet all of una o, how unah dey.
I welcome unah today again to this our ogbonge naijapidgin blog....

Our torey today go carry another different swag and I want make everybody for shook mouth put because nah wetin concern all of us.......

Today make we yarn about second chance, how we take understand am, and wetin second chance go do for us?

As I dey eh, I believe say everybody wey dey dis world deserves a second chance.
E fit be love or broken relationship, elected post, deadly mistake, or judgement day self.

I know say all of us wey dey here don reach different different places for this life and also don do plenty mistake wey we go d wish say, if to say Dem go fit give us second chance.

My own torey/experience wey I been wish say dem for give me second chance be say.
wen I just land for this steemit platform, as blogger and person wey like contest. Na im I just enter one contest like that all for say make dem upvote me. Everything sha dey funny dat day as d organiser just flagged the post come replied me say my entry no correct, cold catch me dat day, na so my spirit live my body.

All I come d think be say make dem just give me second chance may be I fit do something wey dey interesting ,right and good.

So, my country people how your story be? Were u don fuck up or Weting b that thing wey u go wish say Dem for fit give you second chance.
Abeg make we chook mouth put for this matta yarn well.
Maybe your torey fit help another person
And make we no forget to make am brief too sha.

10% of this post payout go go to the person wey him comment get enough people dey follow am argue inside and the one we get plenty upvote.

nah horlaide@horlaide bring this post before oliverwilliams@oliverwilliams help us arrange am for we naijapidgin.

if you like join us for tellegram click here

nah mittymartz@mittymartz help us arrange this beautiful avarta

SECOND CHANCE | Ecency