Naijapidgin Sunday contest

Words
199
Reading
1 min
Listen
Play
8y

Happy Sunday better people. Yes o, week don end and another week don start again. How una dey? Make una go church o today, if you be Muslim well una dey fast so we know say una must to pray.

Okay wetin we get for una today? We don carry our crazy dressing contest come again. Hahahahaha unah still remember abi? The last time rosyblessing@rosyblessing give una race with her tomboy dressing. Make we see who go challenge her today again.
FB_IMG_15267973784411491.jpg
Anything crazy

Oya e simple, just dress crazy dressing snap am drop am here for d comment section. No need to bring people come upvote you. If you want reesteem because you love us no wahala but e no dey compulsory.

This contest go end by 6pm so if you drop picture after 6pm na OYO be your case. Last last we go go discord select who the winner be.

Wetin the person go win? Make I Neva talk am yet. Oya wetin you dey wait for, carry go jor.

Oya join us for discord for here

Na zizymena@zizymena bring this one come and na oliverwilliams@oliverwilliams come post am.

Na mittymartz@mittymartz design our avatar.
IMG_20180215_155325_695.jpg

Una Happy Sunday o.

Naijapidgin Sunday contest | Ecency