APROKO GONE WRONG 馃槀

Words
722
Reading
4 min
Listen
Play
3y

My people I hail o. I double twale for all the broses and sissies wey dey for zanga. Make una no vex for me but na Pidgin I wan use yarn this matter because na im go do me tok am as e dey my mind.

As I dey laik this now na rant on top vex wey I carry enter here today and I wan make una help me reason this matter wey be say why some people still never learn to mind their business?. Why be say some people go dey look for how to pour sand inside person garri?

As the country dey laik this wey everyone suppose to dey hustle for im own thing, some people still get time dey carry another person matter for head laik gala, dey chuk mouth for business wey no take anyhow consain am.

As in eh, person go just comot from im house for morning and as e dey waka for road na to dey monitor another person motor and where e park am come dey reason why e park am there sotey e go get morale make call becos of am.

Oya make I tok the matter proproly (in Zeburudaya's voice).馃ぃ

Na yesterday for evening wey I don come back house after the day's hustle. I just dey for kitchen dey arrange some kain things na im my neighbor's phone ring, you know say e get some people wey their phone dey ring out wella wella, not for me. As she pick, next thing wey I hear na laff, dat kain one wey if dem laff you, you go wish make ground open a d kpai you馃ぃ.

As I hear the laff my aproko ear open sharparly sharparly, but no be say I like aproko but you know say some people no sabi talk small small for call. Dem go wan tok laik say na community people dem dey discuss with. 馃ぃ. But me I like am because of she no tok loud laik dat, I for no hear wetin dey sup and I for no bring the matter here for una.
As she laff finish next thing I hear be

You say you see the motor for the front of so so hotel? Na my husband park am there, the motor no good. Yes, na for that mechanic workshop wey dey close to the hotel im dey work im motor.

Next thing she tok after the caller don reply

Oh, you pass that place, see the motor come recognize am come dey call me for wetin now?
Abeg make you no dey reason me dat kain thing, nothing laik that dey occur. She cut the call.

My eyes open laik this waaahh 馃槼馃槼, the shock wey I shock pass electric shock. I was like, eh people still dey do this kain thing.
Who born you make you carry phone dey call me say you see my partner for so so and so so place, you dey ment. I go change am for you that day.

So if this lady bin no know about the motor issue before and she hear this kain okpata for the caller mouth, she for dey reason say im partner dey waka kurukere waka and una know say this kain aproko fit cause wahala for the family. Matter on top matter go come dey rise.

Na waoh people dey try o. This one no be that the type wey dem dey act for African magic wey we dey watch, I don take my two koro koro ears hear am as e happen for my area.

I like the way wey she take handle the matter, that caller no go everly carry im phone, call dey yarn that kain okpata ever again. As she put am for im place, carry shame rub am for face, e sweet me wella.

Na here I go drop pen becos my ink don finish.
As you read this post no forget to drop comment make we reason. If you no fit for pidgin, carry English drop am, nothing do you.

Till I come una way again, no forget say na as you make your bed na so you go lie on top am. If you no wan abuse for this life, mind your business.

Na still luchyl, the #threadsaddict.

Image Source

APROKO GONE WRONG 馃槀 | Ecency