Mistakes get Levels

Words
158
Reading
1 min
Listen
Play
9y

I salute all my padi and my oga dem, wey dey read dis my tori,

IMG-20171005-WA0001.jpg
Imagine say my shop na like 20km from my house but na trek I dey trek am...
Hmmn one fateful morning like dat wey I don trek tire reach shop na im I cum remember say I no pick shop key
....oh boy I wan cry but I keep am shaa because I be man..
I drop bag start to dey trek go house back, to go carry shop key, as I dey leggo, I cum dey pity myself one spirit cum dey disturb me ooo for road but I bone am,dey trek go house..
..as I reach house na Im I cum remember say I don forget house key for the bag way I drop for shop.....IMG-20171020-WA0005.jpg
.

.oh boy, I sit down cry oooo馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶馃槶

IMG-20171012-WA0016.jpg

follow me make you for fit dey see my new-new post dem. If you dey gbadun me

Mistakes get Levels | Ecency