Confused Love Matter 💏

I greet una my country people... And I de welcome una to this Naijapidgin ogbonge blog
Abeg as e be now.... I need to know watin una go do if this matter meet you

heart-48522__480.png

image credit

I meet one bobo 7days ago and me and this guy don de chat de call since and I come say make I visit this Bobo on Saturday, we talk wella but the guy no "DO" me xha and when night don de come I tell the guy say I don de go house and the bobo start to de beg me say make I sleep for him house that night, na so him friend sef come de beg me too.... But my body no gree me stay.

IMG-20180403-WA0002.jpg

So easter monday yesterday me and this Bobo comot again and the Bobo still say make I follow am go house and I tell am another story why I no go follow am.... The Bobo call me come de Para say I de post am and him wan "DO". so the bobo come ask how much to take "DO" me and I like this bobo ooo and na everything wae babe de find for man the bobo get...
The question now na say How I go tell the bobo and him go understand say I no b Olosho.?

Na @mittymartz bring this matter come today

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design this avartar for our ogbonge community.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center