My Country people una doh oh!
Before I tanda ontop this talk-talk mata today, I for lyk troway salute give d lovely shenkehs wey arrange this package put so. @Ogoowinner you too much eh, make baba God bless you for all we people wey you don hep dia career so.
Ehen! Today, I wan tell una one pure tori about how pesin wey I tink say na my padi, chuk hand for my eye sake of say I no reach.
No be small tin oh... E don reach lyk 5 years now wey I for take know this guy. He no been get wahala at all dat year, infact eh, if no be to say na man him be, I for dey reason one or two... No tink am.馃槈
Back in dat year sha, dis guy been reason me say him for lyk make we for stay together onto roommate mata. Me I no bee get issues with d plan, in short eh, na exactly wetin I tell am be dat. Reaching time for rent payment, tinz cast for dis guy sake of say im papa kpai.
As a guyman, I reason my guy him own part of d rent money plus oda tinz wey we been need dat tym; evritin been dey my head. E no been easy at all, I no go lie.
Na dis part wey I no want make una mix up: I no been dey do any of dis tinz with d mind say dis niggy go pay me, you grab- na just guyman level I been dey on.
After some years now, this guy come grad and one of him papa padi sign am up sharp-sharp. In less than no tym, my guy come dey chop up. The mata gimme joy.
Just last week, I jam this guy for one of our guys party, dis ma guy don dey mob eh! D ride too go me well, I no fit shout. With dis sweet mind, I waka say make I go hail my man based on him doings na as e be say e don tey reach lyk one year since we last talk.
E go shock u wetin d guy yan me. He talk say, I don come now as I see say pepper don ripe, I wan come chop. He even talk say him don dey observe me since say me, I be gold digger...
Till today, my country people, I never still recover from d shock. Some people just get am for body sha.
Make I end am here now abi I neva try. Na so e be. Make una jollof, I don waka.
Source