U go see that money no go ni
Abi wetin be the reason u dey threaten me with ignore? 馃槀
If no be something dey pain u, u no go talk that kind thing
Emotional ke? Because I not using emojis.. I actually laughing as I talking to you. Lmao
You wan beat me?
Na napoli be d small issue
His eyes dey Saudi or PSG
PSG no wan work, so left with Saudi but small complications dey
Nice nice. I actually after him being pay very well. Forget it's my club in question. I want them to break a fucking bank for a Nigerian player honestly
We can't say
Hands fit dey touch you for where you sit down
Wetin u come think say me dey do?
I don roll tire for ground dey even do Snapchat with the newly acquired ring light wey my neighbor buy 馃槀
We dey do video
That money dey important
Dey play 馃槀馃槀馃槀
Emi ika
In this ge, one stupid Injury fit show and career gone
Even d legacy, u no go see do
If Chelsea wage go dey upped, he may consider walai
Chelsea dey do like werey
Lol.... Na because u de mention emotional na. Come be like say na today u add me for this group
He is after his wages
Na d koko for be that
I mention cos u dey threaten with ignore 馃槀
I just dey laugh
No matter what o.. As long as it's football matter.. It ends here on keyboard
Haha. Lol
Shey u wey wan ignore go still later no ignore
No be threat brother mine.. Na small question I ask
For wer ur ika stop, na there another person own start from
U don dance without music before ba
Hehe, choose wisely o
Cos these days, even me dey ignore myself o
No come add to my problem