Adulthood na scam. Many of us are adults now. Bills choke from left, right and center. How is adulthood treating you?”.
Omo if you ask me , na who I go askkkkkk. Omo adulthood dey choke o,make I no lie , e be like say I go soon faint but somehow , I go wake up push again , Omo this life ehn , e just be like make I go back to when I still be pickin wey no get bukata . Omo bukata dey choke me wella. But sha God dey.
We go survive somehow.
”As an adult, what is that one thing that keeps removing money from your pocket?”
Right now wetin dey Comot money pass for my pocket na my kids expenses like before I go wake up I don dey think of things wey dem need to take survive. Also another thing na data and feeding myself . You know say peerson must chop somehow. Omo God dey sha . Na God I dey look so .
Na why I say make fash host me for three days @fashtioluwa you no gree host me . Everybody with adulting.
I just wanna be a baby even if na for three days I go happy . Abi make @samostically come host me three days 😂.
@justfavour I'm curious wetin dey Comot money for your hand?
RE: Sam’s Hangout #78-”ADULT STRUGGLES”