How far my people @nkemakonam89
@sperosamuel15
@hopestylist
@floraada
@justfavour
@mrenglish
@stevenson7
@depressedfuckup
@moremoney28 abeg make ona come help me o 😩
I don go make new year resolutions finish, I don begin procrastination again.
DO YOU HAVE RESOLUTIONS, WHAT ARE THEY OR WHAT IS IT?
To exercise three times a week... The year don start since six days ago, na one place I dey sit down for inside house since then 😂
To eat a lot of fruits... Na only banana I mistakenly chop wey my dad buy come house one day like that 🤧
My hive goals plenty, to publish one post a day don dey hard since I set the goal 🙄 shey I for nor set the goals abi?
Make ona put mouth for this matter abeg... Resolution don dey resolute me 😩😩
WHAT DO YOU THINK YOU WANT TO CHANGE THIS NEW YEAR?
- I nor wan dey find trouble again
- I wan dey do giveaway again
- I nor wan dey dull for money matter again
- I nor wan dey grow my Hive power slowly again... Whale ways
Any problem with my changes for the new year... Let's see in court, I nor dey plan to allow anybody oppress me this year too 😂
I dey here, come at me one after the other... I strong reach all of una 😑
RE: Hive-Naija Weekend Engagement #53 - "RESOLUTIONS"