RE: RE: Hive-Naija Weekend Engagement #71- SHARE A QUOTE
You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #71- SHARE A QUOTE

Words
88
Reading
1 min
Listen
Play
1y

O boi, good morning and happy Sunday hive brethren. Rain don dey fall for my side since yesterday. And na yesterday I talk say make I wash clothes o. Wetin I wan wear go work tomorrow like this. As I dey think about how I wan go work tomorrow, I come see quote wey talk say "Wahala no dey finish, but you sef no be transformer, rest small. Even Nigerian transformer dey rest"

E be like I go call in sick.
How Una take see am sam.hangout@sam.hangout ?

@johnmitchel: O boi, good morning | Ecency