MY PEOPLE MY PEOPLE!
I don carry me and my small Yansh waka come back here again ooo, with my Oga @imbigdeee and all the naijapidgin crew to come pepper people wey no attend the variety show.
Shebi I been tell Una! The show been be hot cake! People don carry giveaways waka oooo, while some carry happiness, joys of excess fun waka go.
Oya you are you happy with your life now that you miss this show
OK! Na our Mama @ogoowinner open the variety show with her sweet voice, she murder the song 'I will lift up my eyes' but her voice con stop for road. πππ
Na im our palè @preciousimo con use he sweet sexy voice render the song fully.
Na so one Keke driver @jackdogho troway one amazing song with him Keke voice on usπΉπΉπΉ
@emekasegun con dey boil like hot water for garri con render one Kpafuka song like thatπππ
@omoyiwolabusayo one babe with the longest name for history come add up one sweet song like that with her sweet voice.
OK! The talent con take another shape oooo. @nonz con enter... omomehn! see poem recitation very romantic
Na im @desmoniac enter with rap... that is, I cut cap for am.
Our baba at the top.
The CEO of poetry @warpedpoetic con land with one gberekete pidgin poem like that... he own burst my Brain. Oya see the poem here
@emekasegun body con dey shake say talent Don pass him own... he con add rap.
Na im I con sing my own song oooo bad belle people con dey vexπππ say my voice too sweet Oya see am hereπππ
Na so quiz come start ooo, people just dey throw in answer anyhow, person get mind say Ejemai name na ejema. Another one get mind vomit say Jeaniepearl na jeanpearlπ’π’π’
Na im person change tojukaka name to tojukaja (hallelujah)
All these ones na spelling errors wey make them loose points oooπππ
Finally finally! After voting @onoz come Carry first for talent show with 1.5sbd
@emekasegun carry 2nd with 1sbd
And @desmoniac carry 3rd with 0.5sbd
Then for quiz after much tumbumtumbum @afolwalex take Yansh commot everybody for road... carry first with 1sbd. Other quiz participants wey try but no reach na
@zoneboy
@kingeazi
@desmoniac and
@jackdogho. The rest wey name no dey here no even answer one question quick. ππππππ
HOT SEAT
Then after the whole thing our Palè, our okrikpoto okrikpota, our the main the main, our baba, our grand papa, our one and only @tojukaka con fall enter hot seat.
Mehn! That one na @zizymena tear am with interview.
Na for the hot seat he take yarn us everything about him steemit journey. We con even find out say na warri guy oooo. Zizy con dey say na im we warri people dey suffer since.
Like me wey dem born for Agbarho, raised and nurtured at DSC, orhuwhorun con dey suffer... Clear road for warri...
If u no be warriππππ
Na for the show oga come gist us about the lady wey he dey crush for steemitπππ
I no go yarn you that one if you want the gist Oya enter the Naijapidgin discord channel here
Our naijapidgin people con ask am questions upon questions. Na im we con give am desire of our variety show, he con say he go yarn the talk well with our malΓ¨ @ogoowinner β
this one mean say he go support with giveaways ooo
You see... Oya if you been no attend the show here is Your giveaway
stretch your right hand sideways place your palms adjacent to your cheeks... Oya knack your cheeks with your palms like say you want kill mosquito. π π π
Oya I Don dey move ooo... you no go like follow me for back? You with your red lips like goat Yansh wey miss this show.. Oya join my area... enter naijapidgin discord channel so you no go miss again. DISCORD CHANNEL
Oya those wey resteem the previous post, check your wallet, if you see SBD, know say you join the first three persons wey resteem. If you no see, Oya try resteeming this one πππ
I remain your WarriCalabar girl @itoroarchibong Oya chop kisses πππππππ