I Win Something from @destinysaid contest.

Words
670
Reading
3 min
Listen
Play
9y

PicsArt_10-21-12.21.42.png

I Greet every body wey carri dia time read dis post.

My body dey sweet me now as i dey write so, i no believe say me self fit win somethin from dis destinysaid@destinysaid contestScreenshot_2017-10-21-14-09-17-1.png
You fit go read am for here

Di time wey i join steemit world, e dne dey nack like 3weeks now wey i join. I still be new comer dat time as i neva sabi wella as e dey go here, na so i cucuma use je-je dey stroll for inside nigeria tag dem. Dey talk for post dem wey i like, till i com jam one post like dat wey destinysaid@destinysaid post, the topic na My life as a producer #3 & enrouth to Lagos Day 1 : The long distances, luck or higher power!

I see sense for the topic, na so i begin read Di post as e dey talk how he hustle be and how street be inside lagos, i com jam the area wey he for talk say he congratulate us wey read reach dis part,

Congratulations! If youve made it this far, youre one of the few who read through the whole thing, . . . or you just scrolled to the end. Either way, im giving out 10,8,7 SBD in that order, to 3lucky participants as part of my 800 followers celebration.

Here's what you need to do.
Write for me, in less than 300 words, in the comment section below, what being african means to you.

See, simply and to the point.

Best answer gets 10 SBD
2nd best gets 8 SBD
3rd best gets 7 SBD

The only rules are that you should place it

He say e dey celebrate sey 800people dem don dey follo-follo am here, sey e go-like dash 3people wey get luck sbd.
He sey e go dash peson wey carry 1st 10sbd, dash peson wey carry 2nd 8sbd, com dash peson wey carry 3rd 7sbd.

Sey make we talk HOW WE SEE AFRICA?
unnamed (3).png
See wia i collect Dis picture

As i be original Africa man, I come talk my mind how me take see am for my own eyes.
Screenshot_2017-10-21-12-43-02-1.png
see my own reason

destinysaid@destinysaid on the beat, make i talk my own mind,

I be black man from Africa and
Original Africa man na black, and black na Original.
After asia na Africa big pass for dis world.
Africa no dey play with dia culture.
Africa na pipu wey believ juju dey, and na dem still go church pass.
Africa political system na wayo but we still dey survive am.
wetin fit kill one africa man fit kill two oyibo man.
Inside Africa na Nigeria be the Giant.
And na Nigeria my mama and papa come from, so i get right well-well for Africa.
So if u be Nigeria you be Original Africa man, no fear.
As Nigeria no dey carry last
Any place wey u go for dis world if you no see any Nigeria man dia, just run for your life ooo.
Make i stop for here

If you be nigeria you be original Africa man.

You Still fit see am by your sef here

As i come back online yesterday becose i been no dey online for some time, i come see 7sbd alert for my wallet, na him i check he come be say na destinysaid@destinysaid send am give me, i come begin wonder how come? i come see congrate sey i carry 3rd for he africa competition
Screenshot_2017-10-21-12-34-24-1.png

I come go check come see sey na
ambmicheal@ambmicheal carry 1st
tezzmax@tezzmax carry 2nd
Screenshot_2017-10-21-12-33-51-1.png
I happy wel-wel oooh because i no know sey me sef follow for winner.

I wan use dis opportunity thank oga destinysaid@destinysaid wey pick me join people wey win, 7sbd for dis buhari season no be mai-mai

I thank ogoowinner@ogoowinner wey dey support me join churchboy@churchboy dem michaelcj@michaelcj dem, i troway salute for all boss dem wey gather read my post.

Thank you

IMG-20171012-WA0016.jpg

Make you dey read my post if you gbadun me.

I Win Something from @destinysaid contest. | Ecency