Sharp Sharp ! No time to waste,yhe answer to this question don dey my note pad e don tey...
I go like make my life partner get three main qualities, i no need much , make him sabi think well,him gats dey very intellectual so make our children sef get papa wey sabi book,dem sef go sabi book , number two be say him must dey fear God,my husband gats dey anointed if not wetin i gain. Finally him must dey humble wey person fit correct am and fit suggest things to am wey fit make us grow as family.
I go fit compromise if na humility no miss, because person wey humble go fit settle down learn and become intellectual likewise how to fear God, as long as e dey ready to listen and learn.But if humility no fey i no sure if i go git follow you before i go go where i no know.
Life no hard.
Make una come ooh,we dey hangout..... come pour your mind, who knows you git find spouse for here.
@xaralight
@amma1
@rukki
@maryann4eva
RE: Sam's Hangout #73- “CHOOSING A PARTNER”