@ionlyspeakpidgin wan introduce him self.

I greet all of una wey dey read dis post now as i dey write am.
PicsArt_10-05-02.41.40.png

My steemit name na @ionlyspeakpidgin, na Nigeria i from.

I go dey write post and dey coment, only with pidgin-english for here.

Pidgin-english you still fit call am "brokin" na the english wey nigeria people dey sabi use talk to themself for street, for market, for outside campus self. inshot e remain small make them even dey teach am for school, even dey speak am for big-big office self.

Anybody wey go school for nigeria suppose to dey hear pidgin-english, If you no sabi am may be dem born you for abroad.

Many African country sef dey speak the same pidgin. Country like Cameroun dem, Ghana dem, Equatorial Guinea dem dey speak am
IMG-20171005-WA0002.jpg

why i say make i dey speak pidgin-english here be say since wey person tell me of steemit, i come begin dey observe other people post both the one wey dey trend, i come see say the oyibo too much, and me no too good for oyibo. "atall-atall na winch" make i no dull my sef as steemit na betta place for men wey sabi, na him make i run join.
why i come begin reason dis pidgin wella be say other comunity like china and philipines and co dem dey speak thier language sef for steemit. So we sef no go carry last if we dey speak pidgin here too.

I go dey try dey post beta-beta things wey good for steemit, even beta-beta pidgin proverb sef. if u na dey support me.
PicsArt_10-05-08.49.07.png

The tag wey i go dey stroll inside na pidgin-english, africa and nigeria na the main tag wey i go dey use for all my own post too be dat.

Pidgin-english na language wey we sabi, even Oyibo dem sef like am but we no know. so mke una dey support me mke we dey steem am.

If you go like advice me, drop am for coment box, make i read am

I thank una join.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center