How steemit don butter my bread.

1501403276724.jpg
How una de steemians, i new to this community but i don sabi plenty things wey de happen for here, my padi don de here before me dem be like Joseph wey don first him brothers enter Egypt go prepare ground, i de thank them well say dem make me sef join this platform.

My name be Odugbesan Tomisin but dem de call me Pastor since i dn de 100 level for my school, na God de behind my back and i thank am well everyday wey i wake up see daylight because no be by my power i de take wake up na by God's grace de avail for me and my family.

Na me be the last born of my papa, I get four siblings i go tell una say e no easy to be last born o e get one thing wey my siblings de do me, dem de treat me wella for outside but for inside house chai i be there errand boy na me de do every work for house the excuse wey them they give me na say dem sef dn work wella before dem born me so na my turn to de work make dem sef de relax, no be small thing o e reach one time so te i go meet my mama say i go like make she born another pikin make me sef relax she just use me laugh say e no de possible again say na nephew or niece i fit get.

My papa on the oda hand no be play play man at all him na no nonsense man, na my papa teach me how i take de read and write, the cane wey i chop for this world wey i come so pass the one wey anybody dn chop, but i thank God say e help me, and i really thank my papa for wetin e dn do for my life, na him be my number one role model, i pray say make any sickness or death no carry any of my parent na my number one prayer be that every morning.

Steemit don carry many things for my hand wey i no fit talk for here sef, since i don de here the way i de take think don change so te the way i de take waka for street sef don change, steemit don make the way i de read and write sef change, even my papa and mama say dem don de observe me say i dn de carry book and biro say wetin happen i no to de serious like this before na, i laugh i kan explain give dem say na steemit change my life o, my papa happy, e say e better say e go make my reading and my writing wild e de very happy for me sef, for me ehn dis platform de very okay gan cause e make me de indoor de do something wey de important and e no to get stress.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center