Wetin steemit don do for me (challenge by @ogoowinner)

image
Here is a side view of ondo state university of science and technology ( osustech)

Una good morning oo, 'cough'. Na so we am o this morning, na pidgin level we dey so oo. Na @ogoowinner organise am.
The thing be say, you go yan us wetin steemit din do for you.

Na my own talk be this...

First make I thank baba God, cos God na bae!
Secondly, make I no mention name oo... I thank all the genesisproject people, una do well for me. My love for all of una, na die oo.

Make I cut the long story short. Steemit do change my life big time oo in plenty ways.
Me way be say, I no like to dey read, my writing na error! I con lazy die, on top everything i no con get money again. Se u understand that kind frustration, way everything just dry, way hope no dey. Na that kind situation I dey before.

But since I find steemit when! Oh my God any book way I see na to read oo
I fit write on top water now, I dey write anything😀
I don gain more knowledge, I don know many thing, I don know plenty person, I don try a lot of better thing.
Steemit con give me money again, na that one sweet me pass.
My life just dey better go.

You see now ehen! I dey addicted to steemit oo.
All my life na steemit, I no wan gree go school again oo😁.
Lolss, thank u for reading. U do well o.

God I thank you ooo
Steemit thank u oo
Anty @ogoowinner thank you
Genesisproject, my very own people thank you oo.
May steem and SBD fall on una
And to all my followers, one love oo

Na still your bae oo
@rebeccafl
Na @camzy make this cartoon
image

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center