Wetin steemit don do for me (a pidgin challenge by @ogoowinner)

IMG_20180114_154444.jpg

Steemians una wehdone oh
I dey bring una hailings from all the way from Uyo, Akwaibom, Nigeria, Africa.

Una sabi as e dey go for this side na, this one na to nack una my confam steemit tori. I wan salute @ogoowinner for this beta chance to take talk this our tori for this naija pidgin style. My pipu to talk pidgin dey sweet but to put am for writing, na dia wahala dey but we go jus try put two and two together.

I bin don this steemit gist tey tey and na oga @samstickkz bin dey follow me yarn am bet i bin no gree put head down, oga @ifioklee com follow put mouth join do make i finally join for November, the year wey jus pass. The thing still bin dey hard me to sabi, i just dump am dey continue my life.

For December, we bin come get one meetup laidat wey @tojukaka @ejemai and @everlyniroh bin talk some kin tins wey bin suppose epp us sabi steemit wella,motivation come drop inside my spirit, i come dey do all the tins wey dem bin talk, i come dey sabi things small small, dey make money small small.

The thing wey i don learn for this place plenty pass wetin mouth fit talk. As i don tire to dey read yamayama wey no get meaning for other social media, una sabi as e dey be na, me sef don dey follow write better sometin, i don follow turn beta blogger.

The love for this community no be here especially for that Christmas time, jolification jus bin dey berekete.
I don meet confam pipu for this place @elizabethscarlet @ungest @ubongj @greenrun @nairadaddy @sussan @annieben @xpressng @datibomchic @teaser1 @jeline @AmbDavid @alisonudeme @emmexdee@ekjosh @dayveedben @kween001 una too much.

I don win sbd and steem brekete for contest wey different pipu don do keep say make pipu win sontin.

Me sef don start community project wey i call Mitup5. This one na weekend meetup wey go epp newbies dem understand how leg dey Waka for this side and how to take jam success for this place.

Na for here i end my tori oh
I salute una as you join me for this one.
Steem on my pipu.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center