Naija Pidgin Challenge! Why I gbadun steemit( make dem clear road, 9ja I hail una)

Omo mehnh, my heart dey sweet like agbalumo. Abeg make omo wobe dem no spoil dis place o!!

I no go yarn plenty tori so the contest go make brain, I go yarn my point sote my next tori go be for ýòřúbá make dem no say we brekete for steemit. @ogoowinner, your brain dey here.

IMG_20180115_194705_151.JPG

Abeg, make una helep beg dem oga patapata for aso rock make dem no sell our heritage.

Why I gbadun steemit.
1.Abeg, since when we don dey Facebook, how much Mark Don give us?? Shishi, I no see, the small boy dey top 5 people wey get money pass on top my data moni.

  1. No bi sey I don collect plenti moni here o but I don receive prayers join am. Just yesterday, I bring two people join, d kind prayer wey one give me eh, e just b like say I don commot am for 9ja go obodo oyibo.

  2. My sister never commot for naija before but she go Ghana last week courtesy steemit. Why I no go happy??

  3. Abeg why I no go love steemit? Why I no go gbadun community wey dey bless people?? If to say our olé politicians for national assembly dey do well, all of us no for dey complain na, abeg God go better your bread very well u wey think of this challange.

  4. Abeg how I for do, where I for take dey read brain wey people like @surpassinggoogle , @ehiboss @ ejimay @Mimi @adejoke16, @tojukaka even u @ogoowinner get? Na for steemit na, I bless God and my sister wey show me this jollificate place where them dey open our eyes well well to showcase better talent.

Make I no talk averything finish for here . I thank una well well, una though, oluwa ma gbè owó yìn sì òké.

Nagode

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now