THE CREED OF LIFE (MY Npc entry for Episode 3)

Una well done ooo, @houseofbella I done come again for this Ogbenge challenge wey our God's favorite @ ogoowinner carry come Again and I go follow .

Me I strongly believe say all man get muscle to be loved and seen.
I know say all man for this world dey equal and all man get equal rights. I know say every man wey dey this world nah one.

Every man get en own talent wey oluwa bless us with. I believe say God created man in his own image for that reason we go dey love our self everyday.

Abegi make I beg una make una dey help people way you dey better than cause baba God tell us say love una neighbors as una love una self, so make your days dey long.

Me I strongly believe in one love so make una believe too,i stand for peace,for unity, for justice, for security ooooo make una believe too. Forgive your brother and your sister make your days be long.

Me I go stand say I go fit make difference for any task way dey on board so far we go be one!

FB_IMG_1516976629317.jpg

Me I strongly believe say life nah journey no be race way you go run, so me no go allow myself enter any kind of competition with anyone because I go stay on my own lane.

Abegi my people make I stop for here and I won use this opportunity to remind una say make una love your brothers and sisters as you love yourself. Thanks a lot to Jesus baby @ ogoowinner for wetin she do for us, madam God go bless you thank you.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center