Why Steemit na my number 1.

IMG_20180116_160029_097.jpg

Ah!!! I don come again oo and I wan talk on this ogbonge pidgin challenge oo. My people una well done o! I day one corner day hail unah! Sister @ogoowinner, our number one ogbonge mama the only original pikin way only she 1, sidon run this kind of challenge way day totori brain kon day burst heads too, e kon follow put laugh for person mouth. Me just day here day say twale to you oo, na u be our better pikin.

Make I sharperly sharperly enter why I day here.
Before Steemit eh, My life no be here oo all because of ponzi even esusu no fit help matters sef.
I go enter ponzi with hope say I go make am big from am but everything just turn kon back fire me as if somebody use wintchy wintchy follow me from village. Ah!!! Twinkas! Twinkas! Each time I remember you my mind go just jump, not to talk of happyflousher and our baba MMM, this ppl drain Me finish sotey dem carry my rent Waka commot.
I enter so many things just to recover I even turn affiliate for konga and jumia as if e no do I enter fiver begin design for ppl just to day earn $5 and I must suffer tire for that $5 because all those clients no get joy, you go do one work plenty times before them go accept am. Mtchw!!!

Make I no too talk sha, but since I enter Steemit, ahh!! I no pay money register but things just turn for good, at least I day get small small something use hold body from Steemit and I no even pay shi'shi oo na just the sweet tin about Steemit. Biko make I pause here because if I begin talk I no go fit stop.
Make una enjoy jare Maka go my oda' room.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center