Making the Steem social network better by @ogoowinner,

My counry pipu,i dey hail u na o, our auntie @ogoowinner don come back with another ogbonge contest,wey she call am Naija pidgin contest.
As u dey read my post go, i wan yarn u about block and delete button, before i start to yarn you my tori ,make i first thank @ogoowinner,@gbenga,@ehiboss with all of una good pipu wey dey make steemit better for us,tiri gbosa for una!!!!
make i first jump enter the block botton matter,una no sey d place wey sweet thing dey happen, wey bad pipu wey dem send cum from village go one put head spoil am. Me wey write post for five hours wey I don crack my metabolite brain,i cun post am finish,na him some mad people will come dey comment Yamama for the post,or make e dey tell me say my post no dey ginger am,why e go ginger you? e resemble igbo ni....and many wahalas dem wey dem dey cause....if tosey d block button dey so...me no go think am twice,i go block all e generation dem,dem go no say man dey hot. They think say he easy to write post.
@ogoowinner if dem fit do this one for me I go blow Dem kiss wey big pass Nigeria.
d second matter about the delete button,this one too fo help pipu like me sef because sometimes ehn,wen i don write a post,if i don post am finish and me no gbadun am well like d good ones wey sabi atract my pipu dem,e go dey do me sey make i delete am but the botton bo dey for am,if tosey d button dey so,i go just delete am kiakia before dem shook eye for the matter.......i dey sure sey all of we na wey dey steemit go gbadun d block and delete button wella.

I won give big thanks once again to our big mama @ogoowinner for giving us this opportunity
God na go dey butter your bread.
i still be that your small boi wey humble like guy wey see e crush............thank you ma ooo!‪+234 810 283 7522‬ 20180208_195708.jpg

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now