I JUST YARN UNA ABOUT THE PIPU PALAVA

image
Image source
My pipu, make una no shock with dis kine style wey i carry com. Na the language wey my mama and papa take train me be dis and I dey very proud of am becus I be confam naija pikin and with una help, we fit show all dose dem oyinbo pipu say we sef get our own language wey we fit talk and na only we we go undastand am. Our people need to bring this language back. Make una reason with me ooo.. Me I dey risinn say dis pidgin language wey we dey see so, e fit bring unity among us.

Dem go talk say na persin wey no go skool dey speak pidgin. Taaaaah. Mak anybody no talk that kine tin again. As una see me so, I talk am for dat my first story wey I yarn una say I dey do my masters for mass-communication. (Talk talk people). Una don see say I don pass tru dis english wella but I don come put the two togeda, I come see say na true wey oyinbo talk say (no place like home) e no get place wey sweet pass your mama house. Na y I come adopt dis pidgin as my own first then Yoruba na the sekond one before oyinbo com show face.

Una fit dey wonder y I dey mix d talk with som oyinbo. Make una no forget say na becos our pipu no wan gree make d language be ogbonge for naija so we neva get any patan wey we go dey use write am. The koko for this matter be say make we try dey put our house for korect place before we commot go awside. make we gather togeda build our own kontri so that all dis oyinbo wey we dey try copy go see sometin to copy from us too. Na dere I go rest my case.
image
Image source
As awa pipu go talk am, dem go say do the one wey your powa go fit cari, make you leave the remaining for baba God to handle.

Now I wan tell una wetin cari me com today. chai if na as we dey wish, na him e dey happen I for like be lawya wey go dey fight for people but as e no happen, I don choose to be palava solver. Wetin I wan dey do be say I go look for pipu true life story, com put am for here make we fit see wetin happen todem so that we go fit tell the person wetin to do and we kuma go use am learn lesson for our set.

No be until u put food for persin table na him u don help. E get some small small talk wey you fit tell the person and the person life go change. E get some pipu wey don taya for life becos dem no sabi wetin to do again. My broad and sista for this, suicide no be option at all. Dis too sweet pass make your no happy. E no gud make we just dey look our persin make him dey go tru hard time na y I dey always try relate with everibodi freely so that dey go fit pour dier mind out. Make we no take dis life too hard make we love people around us. Make we try to make the world better place.
image
My people, I dey beg una well well, only me no fit do this tins. I go need make una also dey talk so dat we go fit dey find solution to people palava. I go want make una sef dey share experience so that I go fit tell this people. Them fit no dey dis community but we fit still use dis community change people lives thru una advice. I believe say dis our steemit community na to add something put for the society and no be for only the money. So make una support me, make we fit achieve this tin togeda. I love una scatter....

In case you self get story wey you want make we talk about, just hala me. I be very free person. If I go and I no recognise dis woman, I be wicked person make una help me shoutout give the mama of the mamas @ogoowinner.

My name na princess Adeola

I JUST WAN MAKE COMMON SENSE

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center