BAD CINDITION FOR WE CONTRY E DON FINISH US; GOD HELP OOO.!

_20180831_100259.JPG

No be small thing oo, as bad condition for dis country don turn person to better liar.

Country don hard reach where father go dey send his pikin make he go lie for landlord say he travel, where he dey hide for corner of door.

Mazi Amadi be dey do well for business, till he go collect money for bank wey them dey call "loan", business come baje reach where he no fit pay am back, because he chuck hand for inside the Bank money take pay his children school money, wey he be dey pay oo without wahala, na so bank people come park all the remaining kaya (goods) wey dey he shop.

Mazi Amadi no come get anything for hand wey go dey bring am money, house rent expire, he no fit pay.

No be if you see food chop, before you go dey talk of house rent money.

As he landlord show like James bond na so he fly abi na dive like peter Rufal enter corner of door.....no be small show, as he pikin no fit put the lie as he father take tell am, wey make the landlord come see am for where he dey hide like rat wey dey run from cat.

Make condition no make you come dey teach your children wetin you be dey teach them because them go disgrace you, and no go bend for situation.

Even the landlord come dey laugh with he wife wey he carry come, the landlord come tell Mazi Amadi wey be his tenant say, make he no hide again, say he too understand the thing wey on ground, country no pure at all, say he wey be landlord know say he wey be Mazi Amadi no dey owe house rent money reach like that....say make he no worry, anytime wey dey money come out make he bring am.

make we dey do good, so that anytime wey level no set, people wey know you go say, this person no dey like that.

Abeg make una no dey go borrow money for bank, when things no dey go well because, e go later hang for your neck. Una doo.

Make I carry beta greeting go meet @naijapidgin for the beta work wey dem dey do for our STEEMIT naija community.... Kudos to una.

_20180830_020251.JPG

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
1 Comment