SEE THE OGBONGE GIFT WEY ALIKO DANGOTE GIVE PEOPLE FOR HIS DAUGHTER MARRIAGE.

My country people una good morning o. How una dey? We believe say we country dey do una better for body.

Today na another day and naijapidgin don carry another ogbonge Tori come una domot. You know who Aliko Dangote be? You go at which kind yeye question be that abi? That na because the name na household name.
imagecredit
Na so news reach us say Aliko Dangote pikin wey Dem dey call Fatima marry her heart-throb wey Dem dey call Jamil. The party no be here o. No so plenty money dey fall left right and center. Na the cars abi na the hall ani na the cake abi na wetin I want talk self.

Aliko Dangote na the richest man for Africa and Jamil papa na the former Inspector General of Police for naija. As you don hear am now you don know say no be small pikin wey were agbada dey go that kind marriage.

imagecredit
To make am sweet pass na so Dem package gifts inside smart travelling boxes nak people wey come grace the occasion.

Na wa! This we country sef. Dangote son no dey see person like me marry abi Abubakar daughter no dey see person like you marry? Why rich dey always marry rich?

na @zizymena nak una this one for @naijapidgin.

You go like join us for Instagram were we dey share better gift dey talk better gist? Oya touchhere

image

na @mittymartz na I'm design this avatar.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center