Naija Entertainment Artistes

Ma country people how una dey, I trowey salute give una oooo.
I welcome all of una to our ogbonge naijapidgin blog.

As una know say today be monday (the day of financial success) na business we wan carry am do.
Our today tori go take another swag another effizzy as we go dey chuk mouth for matter wey concern our naija entertainment artistes.

Who ur artist be?
How we take reason the matter, as I believe say everyone get him own entertainment artiste, se na comedian abi na film or music industry ur goons dey, oya make we talk am.

@naijapidgin entry

IMG_20180305_065004_885.jpg
Source

Dis guy na my real G, him name be Olamide Adedeji a.k.a Olamide. He dey known by most naija pikins and im popularity be like whale's own for this our community.

How I Take Like Him.

Ma koko reason wey I take be a fan of dis guy be say he truly belongs to d street, I believe say u grab that word 'Street', na always him dey give out to the street both money and music trends. Also him dey always praise his naija people with love and good heart.

So wetin we wan make una do be say:
U go upload ya correct artist pictures and the koko reason why u take like him/her or be him/her fan..

Person wey yarn correct thing stand a chance to go home with a recharge card tonight.

No forget to follow us for our tellegram group tonight , if u neva join click here

Na @horlaide create dis post for naijapidgin

IMG_20180223_122656_371.jpg
Avartar designed by @mittymartz

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center