HOW YOU GO TAKE ACTIVATE 9MOBILE DATA 1GB FOR 200 AND 5GB FOR 1000

image

Source

my country people, I don carry another ogbonge one come una domot. Una know say this we steemit work dey chop data wella and many of us dey complain say data we were load now now dey run like tap before you know everything done finish and where the money to dey buy buy data? Na im @naijapidgin come see this beta one say make e follow una share am.

Them dey call am "special data" and you go get 1GB for 200 naira and 5GB for 100 naira. The plan na for people wey like data but no get money to dey buy. For this post, we go yarn una how una go to activate this special awoof and how long e go last. The thing wey make sense die for this levels be say you fit do am for any phone weda na blackberry you dey use o or na Android or na symbian abi na Java abi modem abi which one you get. E no require VPN before e go work. Oya tuale for etisalat.

With just 200 pere you get 1GB data to browse, download and even watch all those videos we you dey like to watch online. But wetin you need to know be say na just 3 days e go work o. So if you do am today count 3days from today once e nak 12pm Dem go carry am go but na better package be this for all of us wey like to dey download wella and we belong to groups wey Dem dey post video upandan and for people wey their apps need upgrade but dey no get data to update am.

Oya make I show una how e dey work.

FOR 200 NAIRA TO GET 1GB

  • Buy 200 naira recharge card from anywhere you like o.
  • Dial 92910# on top your phone and then wait for the text message wey dey go sama you.

For 1000 naira to get 5GB, just do wetin you do ontop 5 times.

Okay my people, me @zizymena Neva try am o but I don see people wey do am talk say e dey work wella. Make una try am yarn us afterall who no go no go know.

Una good morning o. Na another Thursday morning be this. Everything wey you dey do, do am jeje. No drink dey drive, no find trouble, life no get duplicate.


Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg

Avatar designed by @mittymartz

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center