CHRISTAIN SAY DEM NO GREE AGAIN..

My country people I trowey ogbonge salute for unah!
How unah dey?
How unah take d hold body for dis we change wey still d touch everybody so?
I believe say everybody dey alright because baba God dey

So dis beautiful morning I bring unah greetings from all of us wey dey for @naijapidgin

Anywhere you dey wey you d read dis post I say GOOD MORNING GEE today nah another Wednesday and nah so work go continue...

unnamed (1).jpg

Today we don carry another ogbonge matter come we domot again so that we go fit chook mouth put yarn better based on how we dey always do before and I know say unah no go fall my hand

As d matter d be yesterday wey nah Tuesday nah him all d catholic Christian wey nah one denomination for christain wey dey we country match come outside come do protest based on d plenty plenty killings wae don d happen for we country and also d protest nah to mourn d 17 people wey Fulani herdsmen kill for benue state.

D protest d very peaceful and e happen for all d 36 state for we country although no be all d christain denomination go protest but e make sense base on say at least dem don do something

The message wey den carry go met we government nah simple and straight say make government stop all this killings wey dey happen for we country

As d protest happen plenty plenty talk come d full everywhere both for tv and internet self nah him I talk say make I carry dis one come based on community wey we be make we reason am.

Unah know say e don tey we dem don d kill people for we country and if something no happen dem fit finish us oo but baba God no go gree sha

So my people abeg unah think say nah d right thing nah him dem do so?
Abi Unah think say even as dem don match so our government go do something for the matter
Abi if you be leader wetin b d right thing we you go do?
Abeg make we chook mouth put for dis matta

no forget to d support us with your upvote comment and resteem so that we go fit d serve unah well

if you want join we discord make you enter here

nah @oliverwilliams bring dis one come

nah @mittymartz give dis fine avarta

IMG_20180215_155325_695.jpg

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now