JOIN #AKPOS in the WAR AGAINST PROVERBS movement...

Wahala dey oh! In a WAEC English Language Examination, Akpos was asked to complete the following sentence & this was how he did it:

He who fights and run away?

Akpos : E don surrender be dat, nah fear catch am.

A rolling stone?

Akpos : E no fit just dey roll, nah person push am.

He who lives in a glass house?

Akpos : Nah rich politician e go be.

A stitch in time?

Akpos : E go prevent further tear tear.

Birds of the same feather?

Akpos : Nah the same mama born them.

One good turn?

Akpos : Nah correct power steering fit do am.

A bird in hand?

Akpos : Weytin e wan be again if no be barbeque. Dem plenty for chicken republic sef.

Half bread is better than?

Akpos : Puff puff, buns or garri without sugar.

A journey of a thousand miles?

Akpos : Nah d person wahala be dat oh. Why e no enter car or aeroplane jeje?

He who laughs last?

Akpos : Get brain problem. Make dem check am oh, because nah beginning of madness be dat.

A patient dog?

Akpos : Nah beta hunger go kill am.

All work and no play?

Akpos : Nah bankers job be dat abeg.

Once beaten?

Akpos : Nah revenge go follow be dat.

A fool at forty?

Akpos : U never see dis country own.......Naija own start @50.

Naija no dy carry last

#SoftWork

#ReadUpvoteCommentResteem

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now