I no like Monday at all but if I fit create my own Monday e go be like-----

I dey thank hive naija for this contest wey them dey bring every week, if i talk true e dey sweet my belly well well , but this week own be like say na em sweet pass because of the topic.

Everybody no say Monday no dey sweet especially we wey dey Nigeria because of somethings wey i go mention for this post as i dey write am and na those things make me i no come like Monday at all.

I get this picture for pixabay

Why i no like Monday.

If you dey Lagos you go agree with me say Monday morning dey be like war for Lagos because everybody dey run commot for hause, if you dey go island for work you go commot for hause by 4:am and na that time sleep dey sweet well well, you go come dey run because if you no commot for hause early Lagos holdup no go gree make you reach work, e come worse say people wey get company for Lagos no dey pity the people wey dey work for them, they go commot money for the small money wey them dey pay you, dey no wan hear say holdup dey so as you no wan make them commot your money you go leave sleep come dey run dey go work.

Wetin dey vex me pass be say people wey dey drive moto go come add money for that early morning, you go come dey think if dem don add money for fuel again, if you check am they no add any money na because say na Monday morning wey everybody dey rush them go use that time make money.
But if dey say make i create my own Monday how e go be?
Oya check am.

How my own Monday go be.

My own Monday go sweet well well because i no say some people no quick come back on Sunday night so dem go dey tired.
For my Monday work go dey start by 10:am so that everybody go reach no be to dey rush, i go make sure say i go serve my workers morning food because i know say they fit no chop as dem dey come.

If i think am well i go tell some people make dem work for their haus for some Mondays so that they no go spend plenty transport money.
Then me wey be Oga i go dey wake up by 7:am then chop better breakfast wey make sense baff carry my bag dey come office, if i reach i no come work real work, i just come see wetin people dey do, i no go stay too much then i go go home go rest.

Conclusion.

But make i tell myself the truth if i do those things wey i talk for up na em be say my company or business no go grow, no be that kin hand person dey take make money come become big man.
So we go work hard and na Monday that working hard dey start, if person miss em target for Monday like this e dey affect the progress wey the person suppose get for the whole week

Abeg Una thank you for this contest.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
7 Comments
Ecency