I dey troway salute give everybodi wey dey involve for this ogbonge contest especially our madam @ ogoowinner because this na opportunity pesin fit express enself with en tory, wey fit encourage others.
Me i no come follow do the first one but as i come hear this one i say i must chuck my own matter give.
Friendly Enemies; my own tory
See eeh make i yarn una, even anytime wey i come remember this tori eeh tears they comot for my eyes. A girl wey i call my Bestie, me and am dey do everything together. Everyone for my family sabi her wella. Even sef as for me, i no too dey make friends but na she be the only pesin wey i go call my friend den.
I come dey expose mysef give her, any pin wey come my side i dey kukuma tell her. As time dey go, e get one bobo...fine bobo wey come say him like me. My pipol him come dey buy me better thing without my request, em come dey much caring apart from wetin him dey get for me cuz me i no even dey for that one, i dey contented with myself.
As we dey parol wella, e get one day wen we come have wahala, serious one o...i come carry the matter tell my so called friend. She come dey pretend say she won settle us dey go meet the bobo for my back. Come tell am say i be badgirl, say i dey cheat on him. Hmm..the matter no be small thing o.
But because say the guy don love me wella, en come one day dey confess wetin him dey do for my back with my friend. As a good girl wey i be i forgive am oo but na so i take end both him and ma yeye padi girlfriend.
See my pipol, this matter no be joke o, make we be careful in dis our yeye world, e dey sweet but pipol go pepper you especially those wey claim dem be friends. This my tori no be nigerian movie oo, i be living witness, phyno be talk say 'Trust nobody, real niggaz dey scarce' na better word be this.
Thanks everyone as una take time enjoy and learn from these ogbonge contest. Once again i great @ogoowinner. Una be baba!