Hello wonderful pipol, I troway cap for everyone wey dey here dey look wetin I dey write because as e be me now eh, my blood dey hot. Why? Because say this episode dey sweet me dey pepper me also.
See eh, the matter wey everybody dey choke mouth follow talk, I like am. Some people no get sense at all. No look my picture look me cuz I fit deal with anybody wey dey mess up, if you do anyhow, I do you anyhow.
Anyway me I go like make dis oyibo dem introduce that block botton so if pesin come carry matter wey no make sense or come abuse you for your comment, na straight to BLOCK. E go even help make pipol cool down, because if you remember say you fit get blocked if you yarn rubbish, your body go cool down.
So my people make them introduce am...nothing dey shelee.. Make I use this opportunity salute our Boss madam wey dey always make things dey go wella @ogoowinner, well done oo and to everyone wey sabi, well done oo.