My kontri pipu, I greet una welli don, I come shuk head for the matter wey our madam @ogoowinner carry put for ground. The matter be say the need to put block button for Steemit account.
Steemit na one of the ogbonge place wey don comot corruptions for our kontri, many pipu wey dey do yama yama work like yahoo and other online scam, some of them ddon they work for here, them talk say this wan ddey legal pa, so na why I wan make oya oyinbo wey put this steemit upgrade some things for this steemit so e go dey better for all of us.
No 1. I wan make they work for that our wallet palava, I no like as everybody just dey see wetin they appen for inside person wallet. I know say steemit na place wey dey very transparent, but make them do am, make e just be your follower alone go get access to your account.
No 2. I wan make them work for the delete palava, so we go fit comot pipu and add pipu wey we want by ourself
No 3. I also wan make we fit accept pipu before then fit they follow us, so many pipu dey wey be ghost follower, wey no just dey active for person blog.
I go rest for here today, if I get another chance, I go work on something like this. I give yu head @ogoowinner, your brain no go burst in jesus name….amen