Make him just talk careless about Ronaldo tomorrow fess
Cos I no see reason for this kind talk
Na play na,u suppose know
Shey my elder brother na Messi fan
And I like dat guy pass Elon musk whole money sef
So y I go swear for ram 馃悘 like dat
That play too huge
On top OGUFE way small moroco kill
Toh person wey think otherwise e no go chop bet till Ronaldo retire
We no go fight each other
I still de find the humour for this thing o
I am happy for you bro
Now he will finish Pep Guardiola
The he will turn Arteta to ball boy
But Chelsea new coach will make hair grow on Erik Ten Hag head tho
Don't forget that
It's part of his deal
You self done forwarded things
Duran to Chelsea is a done deal
Omo! My club no serious
Na basketballer abi na footballer...na everything una wan buy
I swear e taya me
E no reach Una own sha,
Na now una real suffering go start
We no de spend like una na...we fit bet bfr season start ooo, we go finish ahead of una next season
Oya drop bet na
Chelsea should come and sign me to help them and buy prayers.
Ten k.
If una top my club I go give u ten k
If we top una u go gimme ten k
Na kelvin Durant brother for basketball
Pin this message, I'll double mine
We no need pin am for this group, I go dm u pin am there
And out of over confidence for is boys, he said he will double is sir
For clarity, Endy supports Liverpool. Ace supports Chelsea.