AFRI-TUNES WEEKEND || African worship songs with Alto Recorder

onos-f(67)
Published in
Music
Words
237
Reading
2 min
Listen
Play
5y


My Ogbonge people, how una dey today na? My name nain be @Onos-f. I dey new for this platform Sha and I like the kain things weh I dey see for here o. Me sef I go like be ogbonge member of this platform eh. Na all about African and I dey proud of Africa well well o. I no go fit see African things comot face like that eh. I must surely do my own small part.

[Screenshot_20220317_075556.jpg](
Me I be church person nain make I say I won do African church music. Yes o, na African church worship nain I won do so. E no get as e be, you sef go like am because I know say you like Baba God wella.

I do this music with one of my students like that. She just dey learn how to play keyboard but she dey learn fast fast. The girl sharp wella. Well, I no want do Plenty talk, just listen to the music jare.

Thank you for viewing my video. Abeg, no forget to tell me watin you think about the music for comment section o and if you fit support me abeg support me 馃檹

The content of this post is original to me except otherwise stated.

Screenshot_20220317_075556.jpg


鈻讹笍 3Speak

I appreciate ksam@ksam starstrings01@starstrings01 and obaro@obaro for this initiative for us to celebrate our African culture. Weldone guys馃檹

AFRI-TUNES WEEKEND || African worship songs with Alto Recorder | Ecency