Life motivation in Pigin language.

Words
224
Reading
1 min
Listen
Play
9y

Life nor fit make sense to you if you nor know who you be. Wait make I ask you first, you know who you be sef? As in, if person ask you weti be your value, you go fit balance tell the person with confidence? Bros! Sis.! If them ask you weti make you come this life you go fit talk? Weti dey burst your head as in weti you like to dey do? Bros, abi na sis u be, you know your calling? You nor fit just dey turn round like barba chair and you know know where you they go. Weti, dey do you self? Shai you know say if you nor get money tomorrow Na your fault. Nor just sit down for inside your room and you dey expect miracle to happen, you go old oh. When you nor want focus and you nor get sense you nor go, go anywhere for this life oh. You need to give yourself value, try to make something from nothing, you be confirmed person oh, you special oh, wait oh, nor allow anybody limit you oh. Nor listen to all those parol parol pipo wei they talk say you nor fit hammer, nor body be like you for this life. Remember say, High tension nor dey produce low voltage oh. Life na sense oh.

Life motivation in Pigin language. | Ecency