All written in this comment is in Pidgin
If English easy, try am! As for me, I cherish you pidgin ðĨ°
Happy weekend to all of una wey reach here today... I be wan bring pizza but e never done so make ona manage dried bread... We must chop something for this movies matter, you gerrit? ð
Special greetings to the questionnaire, e be like say he or she don watch one kind Nigerian film wey get as e be this week ðĪ I too wise abeg! ð
My experience with Nigerian movies be like "God abeg o" ðĪĢðĪĢ "wetin be all this ones" ð or "Shuoooo" ðĪĶââïļ you go understand if you don watch "We shall see" ðĪĢðĪĢðĪĢ
What is/are your Favorite Nigerian Movie(s)?
E dey hard me to pick favourite movies o
But if na for Nigerian movies, e easy small... Any Nigerian movie wey Aki and Paw, Ramsey Noah, Pete Edochie and him pikin, Mercy Johnson and all those ancient of days actors and actress... Anyone wey them dey, namy favourite.
I tell you say, e nor go hard to pick my favourite movies ðð
My wiseness don dey too much, I know ðĪŠ
Anyways, I like RMD movies too ð
Na wa o, this girl nor get favourite abeg... So far the Nigerian movie dey well, na my favourite.
Is Netflix really helping to improve Nolywood?
Yes o, I get nice viewing movies from them and the subtitles dey help too but I nor sure say that na the improvement wey person dey find ð nor be Netflix dey make them show dog wey dey fly for air ð
So e be like say Netflix nor dey help o
Them just dey manage our movies like that dey go... We move.
How far @schola.kosy show show
I wan carry you come where you know and you go like ð
Just read the post, comment and engage with your fellow Nigerians... Nor worry, say the thank you later because you go enjoy am ð
RE: Hive-Naija Weekend Engagement #47 - "Favorite Nigerian Movie(s)"