I dey troway salute give everybodi wey dey involve for this contest especially our @ogoowinner because this na opportunity pesin fit express enself with en tory,
WETIN FRIENDLY ENEMIES DON DO ME
Mah just chuk mouth straight to my matter..
Pesin I wan talk now na my tyt padi ,if eim see this post ein go know say na him sef.
My problem be say I get trust issue. I trust people sharply.
My story na money Mata sha. You know say na anything wey money dey involve, you go know your real padi.
So we get admission for the same school and me I bin no dey close.. So he tell me say he go help me find house and do some urgent clearance before I go com back do the rest...
So I trust am as my guy ni,I come send am dope moni make arrange things for me.. I go call am,he go dey give me assurance say him dey do am, and the thing no easy..I come dey pity am sef.
So as the matter be as I com back to see my lodge wey I don pay for and some clearance stuff wey em don do for me...my friend turn brother come dey tell me stories that touch d heart.. The thing pain me wella as I com dey regret why...
Mah encourage us we gats to watch out for manipulative people who be experts in manipulation tactics. Na matter of fact sha. You no go know say you don be manipulated until e don dey too late. These individuals figure out what your ‘buttons’ are and push them to get what they want.
All around you, ein get people you go regard as unfriendly friends. They fit be people you sabi all your life,them fit be part of your family but dey no go add anything to you. You beta fashi those kind people...
Una weldone ooo