NAIJA PIDGIN CHALLENGE: WHY I LIKE STEEMIT

marvelking(47)
Published in
#npc
Words
248
Reading
2 min
Listen
Play
9y

Steemit pipu I greet Una o
My name na marvel..I bin don dey watch steemians dey talk how Steemit don help their life..
I com talk say me I no fit carry last as 042 boy wey ah be
image

ogoowinner@ogoowinner u do well organize this kind thing for Nigerians...I know say Steemit community go hear am as dem dey see all these pidgin posts
Dem go know say wey Naija dey ooh

STEEMIT don bless my life everly I no go deny am i swear
But the kind tin wey make me join Steemit be say u no go pay before you join make I talk true..

image
Credit

BUT MY OWN ENTRY

The FIRST be say Steemit com change me I com dey talk with authority Sake of say wallet dey Breath馃槀馃槀
I just earn if unlike facebook u go dey waste ur time
Steemit help me forget other social media
But e no too easy here I swear馃槀

I like Steemit coz eim com make me dey think deep and fast now, com Dey do research as if na exam I dey prepare for..
All of dem join馃槀馃槀

Another thing wey I like here be say e don expose me wella to many people wey I never know say I go sabi dem
Steemit don make me small boss for my school sef
Make I juss stop here coz I no fit talk all of dem now
NA SO STEEMIT CHANGE MY LIFE OO
God bless Steemit馃挴馃挴馃挴馃挴馃挴馃挴馃挴馃挴馃挴

NAIJA PIDGIN CHALLENGE: WHY I LIKE STEEMIT | Ecency