Afri-tunes Week #76 || A Cover of Idinma by Judikay @jesus-son

Words
420
Reading
2 min
Listen
Play
3y


Screenshot_20230820-160629_PowerDirector.jpg

Hello Hive Afri-tunes week #76, my name is jesus-son@jesus-son and here I come with my entry for the week. Omo I don dey regular for some time now o, oboy I dey try abeg, hehe. Upon the shege wey I dey see for here, I still dey hustle to do something. Infact, thumbs up for myself 馃槄馃槄

But wait o, I too like play o, see as I just dey praise myself. Chai! Village people strong for my matter, lolz.

Ehe, abeg make I talk matter wey carry me dey here. Gbam! This is a post that I wish to share an interesting content. A content that gives me so much joy. And that is music. Maybe it's because I can't do without music, that's why I still can do something despite my tight schedules. God good abeg. Wey my babies rukkie@rukkie emyekanem@emyekanem and who again make I call sef.... ah I no go call gloriaolar@gloriaolar cos na first class babe make she no con serve me breakfast, ahan my new recruit deraaa@deraaa: abeg make una just help me tell God thank you. The Guy don over try for me aswear. Na only me understand so just forget wetin e do for me, just do your part, hehe. ahan let me also invite my Yankee guys stickupboys@stickupboys to join me and bless God. oya let's go ooo

Screenshot_20230820-160455_PowerDirector.jpg
that time the song touch the spirit 馃槄
Ah! Too much play play worry me. So I will be doing a cover of the song by Judikay titled "Idinma". The song make sense die and that's why I love it. It is a song of thanksgiving to God for His mercies and favors. It is a good thing to thank God and acknowledge His goodness. That's how we know the grateful hearts.

Just calm your nerves sit tight, watch, listen and enjoy this piece I render to you. I enjoy myself die as I dey make am, hehe. So enjoy with me. Thanks for visiting me. Byeeeeeee!

Screenshot_20230820-160510_PowerDirector.jpg
E con b like say I fine 馃ぃ馃ぃ

lyrics

My eyes have seen
My ears have heard
Of Your mighty deeds and powerful show of love towards me

Good, good Shepherd
Good, good Lover
I join the angels to shout loud Your praise

I di nma
I di nma
I di uku
Onye n'eme mma
I mara mma n'eziokwu

I di nma
I di nma
I di uku
Onye n'eme mma
I mara mma n'eziokwu
Full lyrics here


鈻讹笍 3Speak

Afri-tunes Week #76 || A Cover of Idinma by Judikay @jesus-son | Ecency