Moo first yakata for floor, for this modmoisselle wey dey burst brain, the nobody finner, nobody richer , nobody smarter Miss @ogoowinner, mama, i too much dey enjoy uuna yanga pu here, you too dey alryt, you shine better pass moon.
INTROMIMO
Na my friend wey gas me jam me for corna, say bidex, one thing dey for coner wey dey promote brain, wey people dey chow grade from, naso i bin dey ask am say na wetin, him come tell me say na steemit.
I been dey think say steam heat, shey na to boil water make coffee he be, or we go dey work for train station, naso he come laff, say na platform, i say okay, bring me the form, maa fill am now now, him tell me say na internet hee dey, i be like shoooo!, why u no tell me say na slay queen arena hee be, him come yakata the mata for ground, tell me say na brain dem dey slay for here, say i gat to put in talent for show, may people come appreciate am, that hee been dey make money from am.
Him come introduce to an ogbologbo platform @genesisproject, say na my oga and oga madam start am to help newbies like me
@ehiboss and
@ogoowinner, na so i graa say gbo gbo 4 unna, unna too much, unna too make things easy for me thanks unaa thanks chineke. Him come tell me say ma do my introduce myself and make sure i raise the flag high.
Raise the flag high wey i hear, naso one blessed guy wey him be oyinbo guy, come dey swear for me for naija pidgin, shoo🤔, oyinbo dey use pidgin tell me say chineke na poogi, i come say oga bros, how far now, wetin i do uuna generation we swear high like everest like this, him come tell me say i flagged him, ohooo, bros i say your post come raise the flag like my paadi tell me, na so him come tell me say i be imbecile, Imbecile ! Shoo, that thing pain me bross oooo, he pain me, my grandpa dey cry for grave, i was only trying to raise the flag high, my people , i fit not eat for seven days , apart say i dey chow some suya.
Thank unna , i appreciate say uuna listen to ma labare, i gat to go now, my beans don dey burn for fire, I love steemit, i love unaa alll.😙😙😙