As e dey hot now for our wonderful NPC, Me i won yarn am as e dey pepper me for body. Our boss madam @ogoowinner, i thank you for bringing up this wonderful matter make we choke head together for.
E get one day, i dey scroll down make i see beta post wey i go comment on, later i come see one kukuma I enter am. I come marvel for the kin comment wey i dey see der, people come dey abuse themselves as pa say tomorrow no dey. The tin come vex me make me want to flag all of them.
See eeh, make we together fire this point well well make oyibo them hear us. We need this BLOCK BUTTON make all those yeyee pipol no come they talk rubbish for pesin post. Make we know say people are not the same, you cant be so patient with everyone. If pesin talk rubbish u come tell am say you know like wetin en do, if em come dey claim right, den blocking follows.
Me i don talk my mind as e be me. I won give salute to everyone wey choke head for the matter. Una well done oo.