Friendly Enemies

Words
334
Reading
2 min
Listen
Play
9y

I twale for all the steamian way dey dis world oo.. My name na Anyebe Gideon..
I say make I yarn una small totori about friendly enemies way my sister get.

E get one gal for my backyard way be my sister friend way just the form like say she be better pikin, anytime way my sister go market go buy or sew new dress, she no go talk say she like am o, she go just shine eye look the dress well well then go buy the same type.. But u see de God way de catch am sometimes be say the tailor no go sew de dress exactly and her own no go even ma fine for eye.
Another of my sister friend na to dey do amebo up and down. Anytime my sister yarn am any totori she go de run her mouth for her other friends. If u ask am she go deny like say tomorrow no dey. She go dey spoil spoil other pipu name for my sister side like say she she be better pikin.
The last one way vex me pass na wen my sister tell one of her friend say she get quanta wit her boyfriend.. De gal just Waka like jet go meet my sister boy friend start to the blackmail my sister say my sister no like am at all, say she de cheat on am since, say she no just get chance to come tell am since way de thing start..
Chai dey tin vex my sister eh.. As God sef wan catch de gal, de boy friend no even mind am, him come cast dey gal for my sister hand. Na wetin come settle dem at last. images.jpg image source: http://craiglamberttherapy.com

The moral lesson from this small story be say make we de careful wit de kind frds way we de chose oo. Nobody dey perfect sha o but oyibo sef talk am say 'too much of everything is bad'

Thank u for reading

Friendly Enemies | Ecency