PIDGIN CHALLENGE- WETIN MAKE ME LIKE STEEMIT

Words
295
Reading
2 min
Listen
Play
9y

People i hail una,my name na Isuaesse, but my guys dem dey call me suarez.
The kind tin wey make me follow diz direction na tinz based on pocket maintenance matter.
Based on logistics as tinz come dey run low, na him one correct guy mritsnobigdeal@mritsnobigdeal come view my case, say e get one platform wey dey for town, say e dey boom based on pocket issues, as me sef come dey follow am reason, i come dey see reasons with am. But still i no believe am true true, how platform go dey free, and e dey pay.
Sha me sef based on my case, wey b say i no like yawa, na him i go investigate am my self, i com realise say i been dey dull map.
Me come tell d guy wey introduce me say, make he show me d way. My paddy help me register for d plattform.
So today i be correct steemit ambassador, pocket don start to get levels, everything for my life upgrade.
Even say tinz been dey dull, ministry no wan grow, but d gee wey bring me come , yarn me say na so him too been start oo, but i been wan give up sha.
But as God want am, i come realise say "to do beta tin, no b waste of time", my jungle come dey grow. Now me na tight guy eversince steemit been waka enter my life. I be proud product of steemit.
Make i carry diz opportunity thank ogoowinner@ogoowinner as she don help lift diz banner for here, she be confam person, so weh done ma, God go bless yo for diz tin wey you carry come.
Diz challengeIMG_20180106_091852.jpg don make me realise say our presence dey for diz plattform.

PIDGIN CHALLENGE- WETIN MAKE ME LIKE STEEMIT | Ecency