P.S: I may not be the best pidgin English writer. Constructive comments are welcome.
Wetin I wan write for here na wetin ai don use English talk before. My morale just say make we use naija tongue write am again unto say na we people we want make dem fit read am and na orlofus fit knack pidgin. The mata na unto the conference wey dey show for we naija wey dem dey call "steemit for naija" conference. Since when naija people don hear about this steemit, we people just grab am. I no blame den sha as akpalakpala dey for pesin wey write beta for there. For this my write write so, I go talk wetin me thinks on top the mata.
First of all for my mind, the heaven wey we dey see so na just where e wan start for steemit 4 naija. We gather plenty people wey sabi write for we country. We dey write about life, romance, fear fear tori, religion and even wetin no real. Plenty better things dey to write down. We people, we tori as we come from before come reach now, we language, places wey we fit flenjor, we chop. As one guy wey we no sabi talk; him say no person fit talk the tori of another person unless the person wey get the tori. Him also talk say no person fit write the tori of another person unless the person wey get the tori. Na him be say steemit for naija go fit make naija people begin to dey write and talk dem tori chuk mouth for wetin dey happen for the whole world.
This carry me go wetin I wan talk next. Na two things go make steemit for naija dey legit and successful. The first one na all the ogbonge original tori wey dey for we country. Another one na the plenty plenty youth wey fit use steemit for naija. One website wey dem call Wikipedia talk say youths wey dey between the ages of 18 reach 35 for naija plenty reach 33,652,424. This one come mean say the number of youths wey dey naija dey among the ones wey plenty pass for the whole wide world. So all this youths begin to dey steemit for naija, e go make steemit for naija successful.
If I come dey the steemit for naija conference nko? E go make me fit follow all the people wey confirmamento and gbadun steemit for naija reason how we go fit to make everything dey legit and to carry the ministry of steemit for naija enter permanent site.
I go jam see you for there. Come block me for there.