I agree say na every person get the right to show himself, talk make them hear and to love person.
I believe say everybody na the same.
I believe say this world big sotai e fit contain everybody
I believe say everyone get brain sotai e s sabi even if na one thing.
I believe say every one special con get wetyn another person no get.
I con believe again say inside everybody na devil and angel. But me I go try make I tie the devil make e no show face
I believe say all this religion na man just do am to use dai oppression people so that one person go con be oga. But me I no go allow that wan disturb me oooo because na baba God do me too.
Me go do people well so that them ma go do me well
Me no go use this my eyes say one person small or one person big ooooo. Everybody get future.
I no go do wetyn my neighbor no like sotai the thing go destroy am.
Nothing go make me judge another person oooo. I go kukuma understand the person.
The things wai I go do no go be because I put eye for another person or I dai envious them.
Before I comot for this planet earth, I go do even if na one thing, something wai go change people life.
When things scatter, abi when things dai pain me for my heart, I no go cru too much. I go dai stroooong.
Fear no fit do me anything.
Me no go allow bad thing wai I dai think tai for my mind. I bad thinking come, I go use good one change am because them say "wetyn dai for mind get power"
Me no go do copy copy oooo because me sef I be original.
I know sai if I do my work well well, na me go carry first.
I con believe say this life wai we dai na travel, no be Olympic. Me no go follow anybody run.
I believe sai make peace dai.
I believe sai make person dai help others.
I believe say make we dai forgive.
I believe sai love sef dai.
I believe sai make we dai show mercy
I believe sai make magomago no dai for court
Me I go change things I no go just dai chop chop.
My name na Albert Martins and I go do these things wai I believe