Una weldone my people i greet una oo.I salute u aunty @ogoowinner for this oportunity way u give us and d plenty gift wey u don dey dash us.
Before i forget wetin bring me come here ,d thing wey bring me come here na d idea wey @ogoowinner bring about block and delete button. Me i for like if dem add so dat bad belle people dem no go dy chook eye for mata wey no concern dem .
Me sed for like if dem add notification and private messaging platform other than discord.
I thank all of una for d opportunity wey una give us dis time to talk our mind for dis mata may God bless all of una @ogoowinner ,
@ehiboss and everybody wey dey participate for dis NPC contest.