The Algerian national team don carry the African cup of nation. Dem really try well well. Make we talk true jare, we been don know say na dem get the cup because as dem take win Nigeria for the semi finals, nobody fit stand for their front again.
I happy for the Algerian team because a good play deserve a good reward. Them play well well with all their strengths and might, so them really deserve the cup. Congratulations to the Algerian team.
Our naija Brothers win the bronze medal, dem sef try their best. Congratulations to them as ein no easy to reach that position.
Football na sports wey dey bring love and happiness. Congratulations to every one of them wey participate for this tournament and to all of us wey support them.