Naija Pidgin Challenge: Why I Like Steemit

baradi(48)
Published in
#npc
Words
308
Reading
2 min
9y
Listen to this post
~2 min

images (56).jpgSilverbird Cinemas Abuja
Source

My people my people, I greet una. This story dey reach una from the Capital Territory Abuja.

When I see this contest by ogoowinner@ogoowinner on why I like steemit, the thing sweet me well well because I don get am since for mind to write on this topic.

I go begin by asking this question: who no like better thing?
I dey sure say everybody like wetin good because e dey put smile on peoples faces.

I like steemit for the following reasons.

Steemit na platform wey provide me the opportunity to express myself through writing. All those matter wey dey worry me like: the poor economy, unemployment, corruption and how man dey wicked him fellow man, I don dey able to write them and by so doing, I don empty my mind off the bitterness.

Steemit na platform wey challenge me to dey creative and original when I dey write. Steemit no dey support copy copy at all. The way I dey write don greatly improve all because of steemit. All those matter wey I been no fit write on before, I don dey write on them now because my mind don open with plenty ideas inside am.

Steemit dey give me money. Each time I post something on steemit, I dey get money and this dey make me feel very happy. Before, e get plenty matter wey I been no fit handle because money no dey but now, all that na history. With the money I dey get from steemit, I dey keep body and soul together.

Now I get many friends both for naija and outside naija. Steemit don link me with better people wey dey contribute meaningful to my life.

Lastly, steemit dey real, e no be fake. Steemit no dey exploit anybody and e no get any monetary involvement.

Naija Pidgin Challenge: Why I Like Steemit | Ecency