Source
My people my people, I greet una. This story dey reach una from the Capital Territory Abuja.
When I see this contest by @ogoowinner on why I like steemit, the thing sweet me well well because I don get am since for mind to write on this topic.
I go begin by asking this question: who no like better thing?
I dey sure say everybody like wetin good because e dey put smile on peoples faces.
I like steemit for the following reasons.
Steemit na platform wey provide me the opportunity to express myself through writing. All those matter wey dey worry me like: the poor economy, unemployment, corruption and how man dey wicked him fellow man, I don dey able to write them and by so doing, I don empty my mind off the bitterness.
Steemit na platform wey challenge me to dey creative and original when I dey write. Steemit no dey support copy copy at all. The way I dey write don greatly improve all because of steemit. All those matter wey I been no fit write on before, I don dey write on them now because my mind don open with plenty ideas inside am.
Steemit dey give me money. Each time I post something on steemit, I dey get money and this dey make me feel very happy. Before, e get plenty matter wey I been no fit handle because money no dey but now, all that na history. With the money I dey get from steemit, I dey keep body and soul together.
Now I get many friends both for naija and outside naija. Steemit don link me with better people wey dey contribute meaningful to my life.
Lastly, steemit dey real, e no be fake. Steemit no dey exploit anybody and e no get any monetary involvement.